MEKIRIUWA WRIT BIG GRAMMAR

 

My pepo, how
unua dey O? Na me O, una piken and una broda, Sitivini Ekiri-Mekiriuwa Ashien
of Ewuru city, di home of my birth. Di city of milk and honey. I say idonte wen
me with una tok O. Nayim icon say mek we tak again because dis kin tin wen dey
happen now, don taya man O. Even sef, wota don dey pass garri. Ibi lik say
every tin don dey dabaru. Even self, ibi like say idey dabaru kpatakpata. My
broda, na only God go save us O, because wetin politicians dem com dey tak our
eye dey see nobi watin mouth go fit tok. Dem com dey do us wayo and jibiti.
HABA. Wetin we do dem? God no go gri O. Even sef, dem com dey doam like say dem
sef no go die again. HABA! Who bi person wen com to dis world wen no go die?
Even sef, my pepo dem wen di politicians dem com dey do al dis bad, bad tin, no
dey talk. Ino good O. Dem go de do my pepo sote, dem no go tok. HABA WATIN.

                You no say dem tok say if you do
Agbor man wel, igo say igood, if you doam bad, igo say igood. Any tin wen you
do Agbor man, igo say igood. My broda, me ano no weda dat kin tin good O. Becos
na dat kin tin wen my peop dey do nayim mak politicians dem com dey tak our
head dey rub sansan. Politician wen you witam be friend befo, befo, even sef,
ifit bi say you witam go farm or even tap rubber (lik me wen tap rubber wel,
wel fo Ewuru befo, befo, wen una small. Wen ibi com politican, igo de denge,
denge lik say ino no you again becos level don change. My broda, we tank God
say no bi man bi God O, becos, if as oyibo dey tok am say man na God, my broda,
wentin dem fo dey tak person eye see no fo let tok O.

                Nayim O, my broda, wen icom see
one Ogbonge newspaper last wek wen com writ jagajaga. Me icom say which can
tori bi al dis? Di paper go writ go here, igo writ go de. HABA. I con say which
kin paper bi dis.? Di paper com writ say one person wen bi deputy governor
befo, befo do dis, ido dat. Me com say lik Urhobo man go tak, sho! Al dis tori
na tru so? Di paper tok plenty; plenty tin O.

                Even sef, plenty, plenty tin wen
itok wen me tak my eye see, my mout no fit tokam atl, atl. Any way, if we no
fit tokam, we fit writam but how we go writam wen di paper tak say one big man
fo Asaba and one big woman fo Ika com dey play football. Di paper no tok di
fild wen dem play di football O. Di paper no tok weda na fo Agbor field abi na
fo Asaba fild dem play di football O. Di paper com sel wel, wel fo Ika land.

                Even sef, some vendors tok say
dem sel one copy fo N500, another one say in sef sel  one copy fo N1000. Me no know weda no tru
tori bi dat O.

                But if di tori na tru, my broda,
na wao! Any way, Oyibo dey tok one grammar say, time will tell. My broda dem,
my sister dem, my mama dem, my papa dem and my friend dem, na here our tori fo
dis wek go end. O. After somtim to com, una go hear from me una piken and broad
again O. But befo una hear from me again, mek every body stay kamkpe O. If your
own pas kamkpe, mek you stay gidigba O.

 

/* Style Definitions */
table.MsoNormalTable

Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*